Tori tok today Monday July 29th say presido Tinubu don stretch hand of support giv Dangote on top di crude oil mata wey bi dey get K-leg and bi wan turn oga Dangote to one motivational speaker since when di oda oga com out com tok say di Dangote refinery petrol bin dey one kai.
Dem tori say di Federal executive council come support di idea wey presido bring comout to sell crude oil for naira give Dangote refinery and oda new refinery for di kontry.
Tori kontiniu say, di federal executive council com agree say dem go dey provide 450,000 barrels for local consumption for naira. Na dere dem for tori say di Dangote refinery nid 15 shipments of crude oil in a year wey go bring di total to $13.5 billion, and dem say NNPC com tok say dem go dey bring four of dis cargoes.
According to di tori, na Afreximbank and other Nigerian settlement banks go com support trade mata between Dangote and NNPC Limited and dis according to dem, go improve di process, as e bi say e go remove many tins wey be dey like international letters of credit.
Dem say dis idea wey presido suggest so, go com also help save money for we kontry and reduce di plenty borku dollars wey we be dey spend take dey import refined petrol.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.