Minister of aviation don tell investors to report any aviation official wey go ask for bribe

Nigeria aviation minister, Festus Keyamo don ask investors to report any official wey go demand for any bribe before dem allow dem investors do business for 9ja. Oga Festus Keyamo tori dis mata for Washington wen e sidon with Boeing aircraft manufacturers executive and oda investors. Him com further address di ogas dem for di meeting say Nigeria door dey wide open for new business, and nothing go frustrate dem if dem com, and if any official try to frustrate dem dey ask for bribe, make dem make sure say…

INEC say na more dan 5000 BVAS machine dem wan use for Edo state election

Independent National Electoral Commission INEC, don tori say dem ready to put for ground more than 5000 Bimodal Voters Accreditation Systems Machines wey we dey call BVAS for di Edo state election wey go shele on September 21st, 2024. Dem com still tori say dem go ensure say di election go go smoothly across all 4,519 polling units and 211 collation centers across di state, as dem tori join say di configuration and installation of di BVAS machine wey dem wan deploy don already complete.

Na cement dealers dey frustration price of cement for we kontri-BUA

Chairman of BUA cement, Abdulsamad Rabiu don tori how cement dealers take frustration di plan wey him bi get to make cement price drop reach N3,500 for we kontri. The chairman of BUA cement com tori dis mata for dia 8th annual general meeting on Thursday, say all di effort wey dem make take reduce di cement price for consumers nor get way becos say dealers frustrate dat effort. and becos of dat dem nor come fit sustain and kontiniu dat policy to reduce price for consumers make e nor…

University of Ibadan students don tori say dem nor go gree for di school fees increase

University of Ibadan student don dey protest becos of di increase of dia school fees wey di school governing council increase for 2023/2024 academic session. Students start to protest as dem see am say dem don increase di school fees from N230,000 to N412,000. Di student say dem reject dat decision to increase dia school fees, and com togeda ask dem di authority to reverse di decision with immediate alacrity or students go boycott dia class until dem get answers to dia demand, of which closing of di school portal…

One passenger don almost scatter America airline kanta with hammer

One America airline passenger don provoke carry hammer dey take scatter di airline kanta sake of say dem tell am say him nor go fit fly becos say di ticket wey him buy na fake. Di video wey don go viral since capture di man as him dey hammer di kanta. Tori say di man bi dey fly to Haiti from Chile, but com decide to stop small for Miami Florida before employees for airport com tori am say him nor go fit fly becos say e ticket na fake.…

Pakistani Authority don hold one 9ja man sake of say him swallow sometin

Di anti narcotic force for Pakistan don arrest one Nigeria man for dia Lahore international airport sake of say dem find 38 capsules of cocaine inside him belle. Tori say di Nigerian man bi pass Dubai go di destination wey dem for catch am with dis amount of cocaine wey dem say e reach 608 grams inside di capsules wey him take arrange di cocaine before him swallow am according to wetin di Pakistan anti narcotic force spokesperson tok. Dem say dem don dey charge di man under dia anti…

Minister of women affairs don warn say any program must involve empowerment

Minister of women affairs, Uju Kennedy- Ohanenye don tori say, any program wey anybody dey plan to hold under di women ministry must receive her permission and must involve beta empowerment for women and children. Minister tori dis one for one event wey she go sanction, sake of say she nor giv di organizers her approval, according to di video wey dey circulate for social media, di minster tori say she don change di narrative and she nor care any name wey dem go call her. Madam Uju com tok…

Peter Obi don lambast di anti Yoruba Edo woman

Peter Obi wey bi Labour Party presidential candidate for 2023 general elections don lambast dat woman wey tok say she go personally start to kpai Yoruba and Edo people. Obi tory dis one for him X handle on Friday, Him tok say him totally condemn di hateful statement and actions wey di woman exhibit, say dat kai behavior and divisive comment nor get place for our community. Obi further tori say as Nigerians, e go good say make di pipo unite and focus to address di challenges wey di kontry…

Some of di pipo for Zamfara don by diaself kpai 37 bandits

Tori tok am say some very very brave citizens of Matusgi village, wey dey Talata Mmafara Local Government Area for Zamfara state don gather kpai almost 37 bandits as di bandits try to wan attack dia community to napkin some citizens for di area. Dem say di bandits dem bin enter di area around 2pm for afternoon to carry out di napkin mata, nai di citizens of Matusgi com provoke say enof is enof, say today na today as dem don understand say all kpai is kpai, and dem nor…

NCC don announce say na September 14 nai bi deadline for SIM-NIN linkage

Nigerian Communications Commission (NCC) don direct all mobile network operators to make sure say dem complete di mandatory verification and linkage of SIM to NIN by Sept. 14, 2024. Na di director of public affairs Mr. Reuben Mouka, nai tori dis statement on Wednesday say dis directive na to make say everybody follow di full compliance of di SIM-NIN linkage policy. Him com tori further say di linkage of SIM-NIN dey very important sake of say e go helep di trust and security of our digital economy.