22,120 students don benefit from di N2.5bn student loan wey dem just disburse

Di Nigerian Education Loan Fund (NELFund), don tori say dem don disburse N2.5bn to 12 schools across di country for di application wey dem receive from 22,120 students. Na Nasir Ayitogo wey be spokesperson for NELFUND nai tori dis mata for one of im statement on Friday for Abuja, im com tori further say dem carry out dis disbursement according to as every school calendar year take dey resume. Dis images na from Nelfund website- (nelf.gov.ng) Oga Nasir come tori further say, all di amount wey dem don give di…

News dey break say PresidoTinubu go address di people on Sunday August 4th for early mor mor

Di spokeman to presido Ajuri Ngelale, don tori for X wey be formal twitter say presido Tinubu go address Nigerians ontop di end bad gwornance protest wey dey shele since August 1st 2024 for nearly all di states for Nigeria. According to di way Ajuri Ngelale take tori am, im say di presido address go happen on Sunday wey be August 4th 2024 for around 7am and make all di media house tune in.