Anytin wey get begining get end

As you dey start your day, remember say, anytin for dis life wey get beginning go surely get end.

And if you dey let dis principle guide you, you nor go wan kpai yourself over some kai kurukere mata wey nor go lead person go anywhere, you go wan treat odas di way you want make odas take treat you, you go automatically mature, sotey you go come realize say you nor dey in competition with anybody but only yourself, becos e go don come tanda for your mendulla oblongata say anytin wey get beginning surely get end.

Di question na go bi say, hope dat end go be wetin u go dey very proud of when only you sidon for your closet dey reason am.

So far so good, nor forget say anytin wey get beginning get end.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment