Enugu gworment don approve N163bn make dem take construction 161 roads

Di secretary to di state gworment (SSG), Prof. Chidiebere Onyia, don tori yesterday to tori tori people for gworment house say, di state gworment don approve N183 billion make dem take construction more roads round di city, and nearly 20 of dis road go dey inside community wey oyibo dey call rural area, and dis go be for di three senatorial districts.

Oga SSG also tori say dis dey happen becos of di plan wey gwornor Peter Mbah get to grow di state economy from $4.4 billion to $30 billion. Him come further tori say apart from di road construction wey gwornor and di council approve, dem com still approve di award of 133 Smart green schools.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment