Presido Tinubu don issue beta warning give gworment officials say make any of dem wey nor get any business to do for di United Nations General Assembly meetings nor step dia foot enter America where di meeting go for shele for September.
Na chief of staff, Femi Gbajabiamila, nai tori dis presido warning give heads of government agencies for di one-day retreat wey dem organize for state house on Saturday.
Him com further tori say di reason for dis presido warning na di step wey di renewed hope administration dey take to take reduce di cost of gwornance wey di whole people for we nation dey complain about.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.