Try to think pass only yourself

One parable tok am say for dis life, anybody wey be say na only diaself dem dey think about without even considering say people dey around dem, say dat person nor supposed to first even dey here.

Dat oda word com still tori am say, nobody be island for dis life, even di island self surround eself with some water in case of incasisi 🤣🤣 as dem tok.

So, as you dey start your day today, especially dis beautiful Sunday, ask yourself weder na only you you nai you dey think about, and if na so, do make you change.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment