Appeal court don direct former gwornor Yahaya Bello to report himself

Appeal court wey sidon gidigba for Abuja don give order to Yahaya Bello wey bi former gwornor of Kogi state to report himself with immediate alacrity for prosecution.

No forget say di former gwornor bi pianteh since dat time wey EFCC, di commission wey dey prosecution any gworment official wey dem fit say e choplate di money dem supposed take work for dia state bi go raid am for e Abuja house, sake of say him get case to answer.

Tori say since dat time after di raid nai dem see former gwornor Yahaya Bello reach, but cho cho say him dey inside e former office wey bi gwornor house dey relax. And EFCC don use style tori say dem nor fit do anything since e bi like say di new landlord use e agbada dey cover the former landlord.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment