171 Nigerians don return from Libya

National Emergency Management Agency (NEMA) don tori say dem don repatriate 171 Nigerians from Libya.

Dem tori say dem receive dis our brothers and sisters for di Murtala Mohammed International Airport for Ikeja Lagos around in di evening, and among dem ma both grown men, women and children. Dem com tok say dem nor record any medical case with the returnee.

According to di tori, dem say many Agencies com tanda for ground to give support to dis our brothers and sisters wey just return, and on top of di support wey dem go receive be say dem go try to giv dem medical assistance, counselling and some business skills wey go helep dem well well, before dem go let dem go start dia new life for 9ja.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment