Ohovbe community for Benin city go start to enjoy 24hrs light

Edo state gworment don go commission 1-megawatt solar panel tins for di people of ohovbe wey dey Ikpoba Okha Local gworment area.

Na Eng Godwins Omobayor wey bi di deputy gwornor nai commission dis project for di community.

Tori kontiniu say di solar project supposed fit give about 2000 houses 24hrs light, dis na according to as di commissioner for mining and energy, Dr. Ojiefoh Enahoro take tori am during di event, him com further tok say dis solar mata wey go give 24hrs light to di community so, dey in line with wetin Godwin Obaseki di state gwornor promise to bring stable electricity, say dis kind project don dey happen for everywhere like Eyaen community and some oda key places to help di people with statble electricity.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment