Abike Dabiri wey bi NIDCOM oga don release d face of di woman wey say she go kpai 9jas for Canada

Di chairman of Nigeria in Diaspora Commission NIDCOM, Abike Dabiri-Erewa, don release di foto of di woman wey dey rake up and down for social media say she go kpai some Nigerians wey dey stay Canada.

Dem tori say di woman wey her name bi Amaka Patience Sunnberger and oda pipo dey get some discussion for TikTok space when she start to vibrate say oda tribes don too sidon for Igbo pipo head, and time don reach to kpai pipo from dis tribe, according to her vibration for TikTok, she go start to put okpor for dis pipo food when she reach work to kpai dem.

Abike Dabiri tori say di woman Amaka Patience don already delete her account for di TikTok and some pipo for Canada don tok say dem go officially report her to authorities for dere.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment