Four 9jas don land for jail after dem forge more dan 2,000 marriage certificate take dey help oda japaris to stay UK illegally.
According as di UK home office take tori am, dem say dese 4 9jas wey dia names na Abraham Alade Olarotimi Onifade, 41, Abayomi Aderinsoye Shodipo, 38, Nosimot Mojisola Gbadamosi, 31, and Adekunle Kabir, 54, dey among pipo wey dey commit crime of EU settlement scheme for oda Nigerians, and base on dis, dem com conviction dem for Woolwich Crown Court for London on Tuesday, August 27 why dem go dey await sentencing.
Dem tori say dem carry out di investigation for both UK and Lagos home office com find out say dis pipo don dey commit dis crime from 2019 to 2023 and dia main priority na just for financial gain.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.