Di National Association of Nigerian Students (NANS) don tori say dem go start protest within 72 hours against di National Emergency Management Agency NEMA wey dem NANS dey accuse say dem use wayo wayo take divert food commodities wey belong to poor Nigerians.
According to di statement wey NANS deputy senate presido Huzaifa Sabo Usman signed, dem tori say dem wan use di protest take draw Nigerians attention to how NEMA take use wayo divert almost 42,000 metric tons of food wey belong to di poor for kontry.
NANS com tori further say dem dey demand serious accountability and transparency on how di food waka, and dem dey give NEMA 72 hours to take respond, and if NEMA fail to respond, dem go carry out di massive protest go NEMA office to go hold pipo wey dey responsible for dis wayo wayo food diverting meant for poor Nigerians.
NANS com still call on all di pipo to join dis fight against wayo wayo so dat dis nation go experience justice and transparency especially ontop dis food mata so wey dem suppose share make e reach poor pipo hand.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.