Pipo for Sokoto don provoke enter forest to go confront bandits by diasef and rescue victims

Thousands of pipo from Gobir wey dey Sokoto state don provoke enter forest, say dem wan go by diasef confrontation bandits wey dey terrorize dem since for dia community.

D pipo say since security officials nor fit protect dem, dem don take matas into dia hand to enter bush by diasef, and dem dey sure say dem go must rescue about 150 victims wey dese bandits carry comot.

But police don tori say dem nor get any informate about 150 pipo wey dem napkin comot from Gobir Emirates for Sokoto.

Di pipo say dem go try to recover di body of dia Gobir district head, Isa Mohammad wey kpai for bandits hand few days ago, and for di video wey don go viral since, u go hear say di pipo dey hala say na fight to finish no going back.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment