Plateau assembly don reduce local gworment tenure to 2 years

Plateau house of Assembly don reduce di tenure of elected local gworment officials from 3 to 2 years.

Na di house committee chairman on information Mr. Matthew Kwarpo nai tori dis one on Wednesday as e dey address tori pipo for Jos, him com tok say dis reduction from three to two years dey in line with di Plateau state independent electoral commission law of 2024 wey dem amend.

Mr. Kwarpo com also tori say dem also take dis decision becos of di local gworment autonomy wey supreme court just approved recently, and e go dey good say since na new idea for di kontri, make dem see as di tenure reduction from 3 to 2 years go take work, and ontop of all di plenty mata, dis step wey dem take so na for di good of Plateau pipo.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment