Some kai protest dey happen for Canada as report say dem wan deport about 70,000 international students

Tori don carry say some kai protest dey go on for Canada sake of say dem wan deport almost 70,000 international students from Nigeria and oda countries dem.

CityNews Toronto also tori for dia report say na some of di pipo from one student advocacy group wey dem dey call Naujawan Support Network, nai giv dem dis figure of 70,000 graduates wey dey at risk of deportation when dia work permits go expire by di end of dis year.

Di gworment don first dey announce some kai tough rules wey get to do with temporary foreign workers, according to di Trudeau gworment, dem say na only small amount of temporary foreign worker nai dem go com dey let enter di kontry and dis go com under very tight rope.

Di administration com still tori say dem go drastically reduce di number of students permit wey dem dey giv out as from September 1st, 2024.

Report say while some student don camp for dia legislative office for place like Prince Edward Island dey protest overnight, silmilar protest dey happen for Manitoba, Ontario and British Columbia.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment