Minister of women affairs don warn say any program must involve empowerment

Minister of women affairs, Uju Kennedy- Ohanenye don tori say, any program wey anybody dey plan to hold under di women ministry must receive her permission and must involve beta empowerment for women and children.

Minister tori dis one for one event wey she go sanction, sake of say she nor giv di organizers her approval, according to di video wey dey circulate for social media, di minster tori say she don change di narrative and she nor care any name wey dem go call her.

Madam Uju com tok say dem dey giv plenty borku money wey reach hundred million for di ministry, and dem see say dey kontiniu to dey use am for travels and to organize mugor mugor programs without any meaningful engagement wey go empower women and children wey dey suffer and need dis money di most.

She say dem dey organize workshops for peace and security, she com dey ask for di video say with poverty how dem wan take solve insecuirty, she say women and children dey suffer, and she nor go sidon dey look ayanyan make di pipo for di ministry dey embark on workshop anyhowness when women and children never chop bellefull.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment