Di anti narcotic force for Pakistan don arrest one Nigeria man for dia Lahore international airport sake of say dem find 38 capsules of cocaine inside him belle.
Tori say di Nigerian man bi pass Dubai go di destination wey dem for catch am with dis amount of cocaine wey dem say e reach 608 grams inside di capsules wey him take arrange di cocaine before him swallow am according to wetin di Pakistan anti narcotic force spokesperson tok.
Dem say dem don dey charge di man under dia anti narcotic act and dem go kontiniu to investigation di mata.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.