Peter Obi wey bi Labour Party presidential candidate for 2023 general elections don lambast dat woman wey tok say she go personally start to kpai Yoruba and Edo people.
Obi tory dis one for him X handle on Friday, Him tok say him totally condemn di hateful statement and actions wey di woman exhibit, say dat kai behavior and divisive comment nor get place for our community. Obi further tori say as Nigerians, e go good say make di pipo unite and focus to address di challenges wey di kontry dey face right now instead of to dey allow tribalism and hatred dey tear dem apart.
Peter Obi com still tok say e nor get wetin tribalism don achieve, especially wen tribalism nor dey reduce cost of any goods and services for market.
Poverty and up Nepa nor know weder you be Edo, Yoruba, Igbo, Hausa or Efik, poverty just want sombori, good leader wey go address poverty issue.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.