Minister of aviation don tell investors to report any aviation official wey go ask for bribe

Nigeria aviation minister, Festus Keyamo don ask investors to report any official wey go demand for any bribe before dem allow dem investors do business for 9ja. Oga Festus Keyamo tori dis mata for Washington wen e sidon with Boeing aircraft manufacturers executive and oda investors. Him com further address di ogas dem for di meeting say Nigeria door dey wide open for new business, and nothing go frustrate dem if dem com, and if any official try to frustrate dem dey ask for bribe, make dem make sure say…

INEC say na more dan 5000 BVAS machine dem wan use for Edo state election

Independent National Electoral Commission INEC, don tori say dem ready to put for ground more than 5000 Bimodal Voters Accreditation Systems Machines wey we dey call BVAS for di Edo state election wey go shele on September 21st, 2024. Dem com still tori say dem go ensure say di election go go smoothly across all 4,519 polling units and 211 collation centers across di state, as dem tori join say di configuration and installation of di BVAS machine wey dem wan deploy don already complete.