Nigeria immigration don suspend one staff wey dey beg people money for airport

Di comptroller general of di Nigerian immigration service don tori say dem don suspend one of dia officer wey social media dey share upandan say him dey beg traveler money for one of di airports. Di comptroller Mrs. Kemi Nandap tori dis one on Thursday through Mr. Kenneth Udo wey be di immigration public relations officer. Di tori kontiniu say Mrs. Kemi don condemn dat bad habit wey di officer wey dem dey call Okpravero Ufuoma display before di traveller, she com tok say dat kind behavior nor show di…

Obasanjo don tori say AI fit help out of school children for Nigeria

Former presido Olusegun Obasanjo don tori say artificial intelligence (AI) fit become beta ogbonge tools wey go help shine light on top di many out of school children wey don almost turn to crisis for Nigeria. Na for di 50th anniversary of learning opportunities wey distance learning institute Unilag organize nai former presido for tori dis one. Obasanjo further tori say Nigeria get almost 20 million children out of school right now and artificial intelligence and open distant learning na some ways wey institutions fit take manage di situation.

Anytin wey get begining get end

As you dey start your day, remember say, anytin for dis life wey get beginning go surely get end. And if you dey let dis principle guide you, you nor go wan kpai yourself over some kai kurukere mata wey nor go lead person go anywhere, you go wan treat odas di way you want make odas take treat you, you go automatically mature, sotey you go come realize say you nor dey in competition with anybody but only yourself, becos e go don come tanda for your mendulla oblongata…

Enugu gworment don approve N163bn make dem take construction 161 roads

Di secretary to di state gworment (SSG), Prof. Chidiebere Onyia, don tori yesterday to tori tori people for gworment house say, di state gworment don approve N183 billion make dem take construction more roads round di city, and nearly 20 of dis road go dey inside community wey oyibo dey call rural area, and dis go be for di three senatorial districts. Oga SSG also tori say dis dey happen becos of di plan wey gwornor Peter Mbah get to grow di state economy from $4.4 billion to $30 billion.…

NDDC don ask youth to register for di 6bn training scheme

Niger Delta Development Commission (NDDC) don tori youth wey dey Niger Delta say make dem take advantage of di special training wey di commission don set up wey go help dem acquire some kai ogbonge skills wey dem fit market. Na Mr. Chiedu Ebie, wey be di governing board chairman, nai tori dis mata when dem dey launch di youth internship scheme for Port Harcourt on Monday. According to di chairman, him further tori say di scheme go help youth wey go participate dey ready for employment. Dem say na…

22,120 students don benefit from di N2.5bn student loan wey dem just disburse

Di Nigerian Education Loan Fund (NELFund), don tori say dem don disburse N2.5bn to 12 schools across di country for di application wey dem receive from 22,120 students. Na Nasir Ayitogo wey be spokesperson for NELFUND nai tori dis mata for one of im statement on Friday for Abuja, im com tori further say dem carry out dis disbursement according to as every school calendar year take dey resume. Dis images na from Nelfund website- (nelf.gov.ng) Oga Nasir come tori further say, all di amount wey dem don give di…

News dey break say PresidoTinubu go address di people on Sunday August 4th for early mor mor

Di spokeman to presido Ajuri Ngelale, don tori for X wey be formal twitter say presido Tinubu go address Nigerians ontop di end bad gwornance protest wey dey shele since August 1st 2024 for nearly all di states for Nigeria. According to di way Ajuri Ngelale take tori am, im say di presido address go happen on Sunday wey be August 4th 2024 for around 7am and make all di media house tune in.