Tori dey report say some pipo wey bi suspected gunmen don kpai Mr. Samson Omoarebokhae, wey bi senior special assistant to di speaker of Edo State House of Assembly, Blessing Agbebaku.
According to di tori, dis mata happen for August 31, 2024, wen Samson Omoarebokhae dey return from Ozalla community to Uhumora community wey dey Owan West local gworment area for Edo state, nai dis suspected gunmen walay am come kpai am.
Ivy Adodo-Ebojele wey bi di special assistant on media to di speaker tori dis mata for di condolence message wey di speaker take condolence Mr. Samson family.
Di speaker com tori further inside di condolence message say him go do everytin wey dey him power to make sure say dem catch di pipo wey carry out dis kpaing.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.