Police don arrest one 19years old Timothy Dauda for Edo state, sake of say him shoot e client, kpai am as him dey wan test di bulletproof charm wey him do for di client.
According to di tori, dis mata so happen for Onumu community inside Aoko Edo local gworment area for Edo state.
Police informate com tori say, di native doctor know how to prepare charm for pipo against gun and cutlass, nai make dis e client wey him kpai so wey dem dey call Alex Ezekiel bi go meet him to prepare bulletproof charm for him, and na as him di native doctor don prepare di charm finish, com say make him test am for Alex Ezekiel wey bi di client body, na so e take shoot Alex with gun to test di charm, but water com pass garri as e com be like say di bulletproof charm nor work as di gun com giv Alex di client beta injury wey com later kpai as dem reach hospital for Igarra.
According to police informate, di native doctor go face prosecution once dem complete di investigation.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.