Bill Gates wey be co-chairman of di Bill and Melinda Gates foundation don tori say na Nigeria nai dey receive di largest intervention fund for Africa.
Bill Gates say him understand why e bi like dat since na Nigeria nai still get di highest population for Africa, and na during di NutriVision wey him and some tori pipo dey rub mind for Abuja nai him for tori dis one, him com tok say him don really spend billion on top Nigeria.
Him com tori further say e top priority na to see say health wahala like measles, malaria and polio finish, and dem go still try to spend more to improve primary health care in di future. Oga Gates com tok say e happy say di rate at which women bi take dey kpai wen dem wan give birth wey dem dey call child mortality don use style reduce.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.