Aliko Dangote, di oga kpatakpata of Dangote group don tori say, since him don succeed to make di petrol mata wey bi dey get kleg since work, make Nigerians know say dia motor from now on go dey last well well, sake of say di petrol from Dangote refinery pure nor be small.
Dangote tori dis one as him dey tori di pipo for one press conference for Lagos, him com tori join say, dis petrol from Dangote refinery pure so tey nobodi for di world in terms of quality of petrol fit beat Nigeria again dis time around.
Oga Aliko com further informate us say as soon him and NNPCL don land gidigba for ground, everybodi go feel it as petrol start to enter market, and dat go bi from industry and manufacturer o, to save foreign exchange wey go help Naira stabilize o and even di beta fresh air we di pipo go start to breathe in from dat petrol wey pure as we see am say him hold am dey show di world.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.