Kim Jung-un don kpai 30 of e official becos of flood wahala

Tori dey informate us say, Kim Jung un, wey bi di leader of North Korea don execution as in kpai 30 of e officials becos of flood wahala wey dem say kpai almost 4,000 pipo for di kontry.

Tori say dem charge dis officials wey dem kpai so with corruption and say dem neglect dia duty nai make di flood fit kpai 4,000 pipo like dat.

Kim Jung-un don tori say him nor go collect any aid from anybodi even doe say di flood don pursue almost 15,000 pipo comot from dia house.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment