I beliv my reader, say yu slip very well, as person tok, na wen person open eye for morning nai bi e early morning, but we thank God for di gift of life and di blessing to see anoda day.
As yu start your day, I just wan remind you say, concerning dat your potentials wey God giv yu, wey yu know say God giv yu, and wey me and yu know say na everyday nai yu take dey put your hand for your jaw dey say chai, I wish say I fit just start dis tin wey yu know say e dey in line with that potential wey Him di creator giv yu as yu dey land gidigba for dis world.
D tin bi say everybodi go always get excuse why sometin nor work, and why sometins nor fit work, yu know why? becos excuse nor dey giv us bill, so we always use am anytime anywhere any day, but unfortunately excuse don com tok say, oga madam, I get consequence o, and one of dat consequences na di weight of regret wey u go dey carri upandan even wen pipo fit say u dey happy.
So, for excuse nor to give yu di bill of consequences las las, I dey beg yu make yu start to do sometin small small about dat potential wey dey giv yu knock for your heart, for your head every morning wey yu wake up, just start small anyhow, and set goals wey go alignment with dat potential wey yu know say even spirit go smile when you start to use am.
Nor forget, d first step for lada na bottom e dey and na one step at a time, nor also forget say na small small water wey dey drop inside pool nai dey become swimming pool wey com make us dey call am swimming pool and pipo com dey use am dey cool off especially wen heat dey. Na so yu go surprise say your potentials go start to bless pipo if yu just take di courage to start.
So, take dat step today onto dat your dreams and potential, and yu go thank WEDIPEOPLE later.
I wish yu a very beautiful Thursday.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.