NANS say dem nor dey plan any fuel increase protest

National association of Nigerian students NANS, don comout tori say, dem nor dey part of di pipo wey dey plan any protest on September 15th, 2024, dem say dem support anything wey go bring peace to resolve di mata of fuel increase.

Afeez Akinteye wey bi NANS senate president nai tori dis one for e statement say, dat informate say NANS dey plan any protest nor carry beta jerrican of water, sake of say dem nor want anytin wey go cause kasala for di nation, but dem support say make di pipo wey dey in charge of dis fuel increase enter beta tok to resolve di mata for di gud of everybodi.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment