Nigeria electricity generation don reach 5,313MW first time in 3 years

Minister of power, Adebayo Adelabu, thru him special adviser for communication and media relations, Mr. Bolaji Tunji, don tori say for di first time in 3years, electricity generation don reach 5,313 megawatts.

Di minister com tok say him go advise electricity distribution company wey bi Discos to collect more power so dat di national grid nor go collapse again, according to am, him say if Discos nor pick power when dem production energy, e fit lead to collapse of national grid.

Di minster com further tori say, by di end of dis year power generation go reach 6000 according as federal gwoment take plan am, and so far, di improvement for di light mata dey point go dat direction say power generation tru tru go reach 6000MW

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment