Poyis don arrest one fake doctor wey go inject patience com kpai di patience for Nasarawa state

Poyis for Nasarawa don arrest Isa Usman wey bi fake docitor, sake of say him go give one patient wey dem dey call Zaki Yaka Ajohol procaine injection wey him say him take dey treat typhoid for Zaki Yaka, wey com later kpai Zaki di patient.

Dis mata happen on Wednesday for Iyayi village wey dey Kadarko district of Keana local gworment area for Nasarawa.

According to poyis informate, DSP Ramhan Nansel, wey confirm di arrest, com tori say di fake docitor wey com from Gombe state only get primary school education, but him com dey pose upandan say him reciv ogbonge training for Asibitin Yusuf in Agyaragu for Obi local gworment area, before him com go giv di injection wey e nor suppose giv to di victim Zaki Yaka wey don already kpai.

Poyis say Isa Usman don confess say him give Zaki di decease dis procaine injection for straight 3days, and na di 4th day nai di patience nor com wake up, and as dem carry am reach dia primary health care, e com bi say Zaki don already pass away.

Dem say dem don transfer di mate go di criminal investigation quarters wey dey Lafia for further investigate.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment