Peter Obi don ask African Leaders say make dem take farming business serious well well

Peter Obi wey bi di presidential candidate for di 2023 general elections and former Anambra state gwornor don advice African leaders to take agriculture business serious well well so dat dem go fit tackle insecurity and hunger for Africa. Na for di international conference for food security wey dem hold for Kigali for Kenyan nai him for tori dis advice. Obi com still tori further say e go beta to reduce dependency on food importation wey go help to reduce di currency pressure and focus more on food production for…

Appeal court don still tori say Asue Ighodalo of PDP remain di candidate for di election

Appeal court wey sidon gidigba for Abuja don tok say Asue Ighodalo wey bi di gwornorship candidate for di pipo democratic party remain di authentic candidate for di election wey go take place on September 21 2024. Dem tori dis one as dem troway di mata wey som Pipo carry go court say make dem disqualify Asue Ighodalo sake of say him be nor get beta voter’s card, as dem dey giv d judgement, dem tori say dem dey troway dis mata becos of say di mata lack merit, and…

Quality infrastructure for china go soon dey appear for Nigeria

Presido Tinubu don tori say him go try to start to make di quality beta infrastructure wey him see for China to dey appear for di kontry. Presido tori dis mata give Nigerians wey settle gidigba for china wey dem dey call Nigeria diaspora organization for China chapter, presido tori say im ready to create di leadership wey go move di nation forward. Him com tori further say China na very discipline society so make di Nigerians wey dey stay dere learn discipline and represent Nigeria as good citizens.

FG don tori say di fuel scarcity wahala go reduce dis weekend

Federal gworment don tok say plenti borku fuel dey di kontri, and base on dat fuel scarcity go reduce afta dem address di distribution issue. Na Sen. Heineken Lokpobiri wey bi di minister of state for petroleum resources nai tori dis one afta him and Vice President Kashim Shettima hold meeting finish. Di minister tori say gworment dey do everytin possible to make sure say dis fuel scarcity so wey dey cos beta hardship for we citizens become a tin of di past Him com still tory say gworment nor dey…

Take one beta dip breathe

As you dey start your day, just know say sometimes di only tin wey yu nid to do na just to take a dip breath and relax, and den assure yourself say everytin go must surely dey alright. Usually, notin dey ever stay di same, e dey go dey com, and di earlier yu advise urself say notin dey stay di same, plus say notin dey new under di sun, di more focus and relaxation yu go put yourself, as far as say yu know say yu nor dey deciv…