Federal gworment don tok say plenti borku fuel dey di kontri, and base on dat fuel scarcity go reduce afta dem address di distribution issue.
Na Sen. Heineken Lokpobiri wey bi di minister of state for petroleum resources nai tori dis one afta him and Vice President Kashim Shettima hold meeting finish. Di minister tori say gworment dey do everytin possible to make sure say dis fuel scarcity so wey dey cos beta hardship for we citizens become a tin of di past
Him com still tory say gworment nor dey fix price of petrol since dem don already deregulation di petrol sector, but once dem fit address di distribution issue, dem expect say prices go com dey stabilized for everywhere.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.