Nigerian hunters and forest security service (NHFSS) com tori on Monday say dia operatives don free one victim wey dem bi kidnap.
And according to dem, dem rescue dis victim along Nri-Enugwu-Ukwu road between Anaocha and Njikoka local gworment areas for Anambra state.
Na ACG Mark Okonkwo wey bi di zonal commander of NHFSS for Southeast nai tori dis mata for Abuja.
Him tori say immediately dem reciv call from som pipo wey dey pass say dem see say di kidnappers dey try to force person enter motor, nai dem mobilize dia men base on di intelligence report dem reciv.
Dem say as di hoodlums see dem, nai dem start to engage dem with gboa gbao battle before dem com trow out di woman comot from di vehicle wey dem bi kidnap.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.