One video wey dey all over social media since, don show some of our kontri sisters for Libya wey nid beta help from gworment.
Dis na becos say according to di video, di women dey hala say dem nid help as dem don dey dat prison for Libya for almost two years now. Dem say dem decide to cry out since citizens of oda nation don find way comot from di prsion facility wey dem put all of dem and na only dem wey bi Nigerians nai com remain, derefore dem dey beg Nigeria gworment to come to dia rescue.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.