Dem say make dem start to fine pvc holder wey nor vote

Shehu Sani wey bi former Kaduna Federal law maker don tori say make Federal gworment start to make pipo pay heavy fine if dem collect dia permanent voters card PVC and com fail to go use am take vote.

Sani tori dis one for e social media handle wey bi X say dis heavy fine so go help address di wey voters take dey collect dia voters’ card and refused to go use am vote.

And according to am, e say di nid to call for dis heavy fine so on top citizens wey dey collect dia card and refused to go vote, na becos say di way wey electorate take dey take di election mata serious don dey reduce well well if dem say make dem start to count since four-decade dey come.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment