Presido Tinubu don visit Maiduguri for di flood issue

Presido Tinubu on Monday don visit Maiduguri becos of di flood mata wey don pursue many of we citizens for dere comot from dia house especially for Borno di state capital.

Nor forget say na di way wey Alau Dam take collapse nai cause di flood, of which according to tori, dem don allocate plenty borku money since to make sure say dem fit control dis mata, but wetin di pipo come dey experience now, nor com be like say dem allocate any money put at all.

Some Cho cho com dey tori say while other parts of di world dey prepare seriously to make sure say dis kai tin nor happen to dia citizens, or even if e go happen at all, dem go try to fix am with available techinology wey borku for evrywhere before e go even happen, and if e bi say e happen, di pipo wey dey in charge wey nor do anything about am, especially wen dem collect money put, go reciv di consequences of dia action, but chocho com tok say our own com different as we dey wait make heaven com down com fix di issue and noting go ever happen to di person wey suppose make sure say dis kind mata nor suppose happen in di first place.

Minwhile, presido Tinubu wey di state gwornor reciv as e land di state go access di plenty damage wey di flood wahala don cause for dere

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment