Former head of state Abdusallami don tori say palliative nor bi solution to dis hardship

General Abdusallami wey bi former head of state don tori say, di hardship for Nigeria don dey go pass out of control and at dis time e com bi like say palliative nor bi di solution.

General Abubakar tori dis mata for one meeting wey him for reciv di leadership of di campaign for democracy and human rights on Tuesday for Minna Niger state.

Him tori further say federal gworment suppose do sometin about dis hardship with beta sit belt and drive with immediate alacrity, and one of di seat belt dem nid to wear na for gworment to make food borku everywhere like ocean so dat pipo go start to buy am chapatico and eat belleful as dia pocket reach.

Na dere di former head of state com use style advise di pipo wey don plan say dem must to protest for October 1st, make dem abeg make di protest dey peaceful.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment