Di command for Nigeria Airforce don tori on Wednesday say dem don start to carry di INEC voting materials with plane go Benin for di election wey go happen on Saturday September 21 for Edo state.
Dem tori say dis na to make sure say di materials deliver on time and securely according to di statement wey Group Captain Kabiru Ali wey bi di deputy director of public relations and information for NAF tori.
Him tori further say dis voting materials wey plane carry so, na di collabo effort between NAF and INEC to make sure say dem fit achieve logistic mata wey go help smooten di election and make am dey peaceful for Edo state on Saturday.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.