Engineer Dotun Sanusi wey also be Ibadan business man don carry electric bus com out, dis go make am di first electric bus and na 100 seater di bus bi. Engineer Dotun com tori as im dey launch di electric bus say make di okada people and people wey dey ride keke nor worry, becos dem go soon get di opportunity wey go help dem change from diesel or petrol to electric.
Year: 2024
Lagos state gworment don tori say Sanwo-Olu nor talk say new minimum wage na N70K
Lagos State gworment don tori say e nor get di time wey govnor Babajide Sanwo-Olu take tok say im don increase minimum wage to N70,000. Na Lagos state commissioner for information nai tori dis one say, di tori wey dey out dere say guvnor Sanwo- Olu increase minimum wage nor correct, say di guvnor only tori say since January, civil servants don dey earn N35,000 as wage award wey federal gworment say make workers dey reciv, and if you add dat N35,000 wage award join di N35,000 wey civil servants…
New minimum wage for workers fit nor happen on May 1st
Presido of Trade Union Congress of Nigeria (TUC) Mr. Festus Osifo, don tori say, di new minimum wage wey every worker tanda and dey scratch ear dey wait for fit nor happen on May 1st. Festus Osifo tori dis mata for Abuja as im dey address newsmen, im com say, di reason why di new minimum wage nor go fit ready on May 1st na becos say di committee wey sidon on top di mata of di increase still dey do deir work and im believe say soon all of…
Tinubu don appoint Jim Ovia as chairman of Nigeria Education Loan Fund
Presido of Nigeria, Bola Tinubu, don appoint Mr. Jim Ovia as di new chairman wey go head di board of di Nigerian Education Loan Fund (NELFUND). Jim Ovia na ogbonge better banker and better business man, and na Friday nai presido appoint am, as Ajuri Ngelale wey bi di special adviser to presido on media and publicity mata take announce am. Presido tori say, di education loan fund need person wey be professional and com get experience join, and im believe say Jim ovia go use e experience and professionalism…
Everyday na fresh start
Everyday wey you wake up and see di morning sun, na fresh start. Dis go mean say, you go try to forget di past and look forward to a fresh, beautiful and successful day. Di rison you nid to do dis na becos, just as everyday na fresh start, na so di day still carry e own baggage, and e nor go good to add yesterday baggage wey don already pass com add join today own wey you never even fit carry. So remember, as you dey start your day,…
Tinubu don approve N100billion as consumer credit for Nigerians
President Bola Tinubu don approve make dem start di N100 billion consumer credit scheme for Nigerians becos of di economic hardship wey dey kontri. Na Ajuri Ngelale, wey bi di spokesperson to presido nai tori dis one on Wednesday. Im com tok say any Nigerians wey dey interested fit visit di portal of Nigerian consumer credit corporation before May 15, 2024. dis na di portal wey di spokesperson say make working Nigerians visit if dem dey interested. “Working Nigerians interested in receiving consumer credit can visit www.credicorp.ng to express interest.…
Multichoice don increase their price for DStv and GOtv
Multichoice don tori say dem go increase price for DStv and GOtv customers starting from May 1st 2024. See as Yabaleftonline take post am for their X handle
Take small steps
Dem say na small small water nai dey later com turn to ocean. Nor think say dat small small steps wey you dey take on a daily basis nor go amount to anything, becos before you know wetin dey happen, if you nor give up, dat small small steps wey you dey take since towards di exact tin wey you know say you want, go start to produce beta result. All you nid to do na to encourage yourself and nor giv up, no mata di discouragement wey dey around…
US Presido don sign one bill wey go ban TikTok
Presido of United States, Joe Biden, don sign one bill enter law to ban TikTok app comot from social media for inside U.S. As dem pass di bill for congress, dem com say dem order di company ByteDance wey be like say na China company, to sell di app within nine months, or kuku face di ban from U.S. TikTok official com later release statement say, dem go challenge di mata for court, as dem say dat kind leg wey US presido carry come dey unconstitutional.
Concerning di fire mata wey happen for Bini
Tori tok say fire don happen for mostly medical shops wey dey opposite university of Benin teaching hospital (UBTH). Dem say na one of di shop nai di fire for start before e com spread enter oda shops for dere, and as di fire start, both di federal fire service, di Edo state fire service, di Nigerian Army school of supply and transport Benin, di University of Benin fire service, and di University of Benin Teaching Hospital, UBTH, com try dier best to make sure say dem fit quench di…