One of our sister don rapa from UK back to naija say she don tire

One of our sister don share for her TikTok video wey bi nikkystar_55, say, she tire for United kingdom wey be UK, and decided to com back to naija after two years, dis one na wetin we go call rapa opposite of japa. Our sister say she don tire for di hussle hussle for Uk and finally decide to return to naija, she com still tori say nor be only she and her family, as plenti japaris dese days don dey com back to naija make dem com take advantage…

Peter Obi don reply Reno Omokri about di school mata

Mr. Peter Obi, wey bi di presidential candidates of Labour Party LP for di last general election wey happen for 2023, don com tori why im nor build new schools when im be govnor for Anambra State. Peter Obi tori dis one wen im hold one press conference on Wednesday for Abuja. Na dere Obi com reply Reno Omokri wey be social media influencer wey say im challenge anybody to show school wey di former govnor build for Anambra state di time wey im be govnor, Reno com say im…

EFCC say Former CBN govnor Emefiele use N18.9billion take print N684.5million

Di Economic and Financial Crimes Commission (EFCC) don file new charge against former govnor of Central Bank of Nigeria Mr. Godwin Emefiele, sake of say im use N18.9billion take print N684.5million notes. Na for High court Abuja nai EFCC for file dis new charge against Godwin Emefiele, and com tok say na im approve make dem print N684,590,000 with N18.9billion. Dem com further tori for di charge say di former CBN govnor broke di law becos im purposely harm di people of Nigeria during di time of former president Buhari…

Gworment don suspend operation for Dana Air becos of safety mata

Nigeria gworment don suspend commercial activities for Dana Airline becos of safety concerns, and na on Wednesday nai gworment direct di management of di airline to suspend deir commercial operations. Na di minister of Aviation, Festus Keyamo nai giv dis direction becos of di mata wey happen with di airline for Murtala Muhammad Airport, Lagos State on Tuesday. Remember say d airline be run comot from di Murtala Mohammed airport runway on Tuesday, although say people nor injure, but di general public dey ask questions about di safety mata concerning…

Jamb don arrest one papa wey go write exam for im pikin

Di Joint Admission and Matriculation Board (JAMB) don tori say, dem don arrest one man and im pikin becos say di papa go write JAMB-UTME exam for im pikin, wey oyibo dey call exam malpractice. Jamb nor mention di name of di papa and im pikin, but dem tori say di papa commit di offence when di Unified Tertiary Matriculation Examination (UTME) dey go on. Na Prof. Ishaq Oloyede, wey bi di Jamb registrar, nai tori dis one when im dey inspect di UTME centres for Kaduna on Wednesday. Im…

A reminder say na empty hand we carry com

E get why God di creator allow everybodi com dis world empty, and nobody go fit question God Almighty why Him do am like dat. But dese days, common sense go don tell us why Him do am like dat especially with wetin dey happen now for our kontri. Now, take one minute and imagine if to say God allow us carry everytin wey we as human being dey like enter dis world, and com also tok say, as we dey comot from dis world we go carry everytin wey…

Citizens don dey lament wetin happen to OKIN biscuit factory wey be dey dat year

One of our active citizens don com lament d yama yama state wey Okin biscuit factory com dey. Na active citizen Mayowa na share am for im X handle how dem take visit di abandoned factoy. Im com tok say na as dem dey com back from Ajasse Ipo for Kwara state, nai dem see di Okin biscuit factory and luckily for dem, dem allow dem enter just to see. Na dere dem shock to see di yama yama abandon state wey di factory com dey. Citizen Mayowa com tok…

Stay Positive

Today I just wan encourage you, and di encouragement bi say, no mata wetin you dey go tru for anywhere you dey for dis world, I say make you just kontiniu to stay positive becos beta days go com. So, as you dey start your day, nor forget to always stay positive and expect say beta days dey com, becos, dat beta days go com. Have a beautiful day.

Former Presido don tell Current Presido make im add private university students join di student loan

Former Presido Olusegun Obasanjo don ask Presido Bola Tinubu to add students wey dey private universities join di students wey go benefit from di student loan scheme. Obasanjo com also tori say im dey very worried as how dem go take handle dis student loan scheme without corruption, and im com still agree say di student loan dey important becos e go help di development of di society, but e nor go good to remove students from private universities, and say im dey hope say di gworment go listen and…

INEC don publish di final list of di candidates for Edo state govnorship election

Independent National Electoral Commission don tory say dem dey happy to announce say dem don publication di final list of candidates wey go participate for di Edo State govnorship election. Dem say dem publication di personal particulars of di govnorship candidates and dier running mate for both di state and local gworment offices wey dey Edo State. Dem further tori say overall, na 17 political parties nai get candidates for di election wey go happen for September 21 2024, and inside dat 17 candidates, 16 na men while na only…