Di Federal Competition and Consumer Protection Commission (FCCPC), don close one Chinese supermarket wey dey China general chamber of commerce for Abuja. And na on Monday nai dem close am, sake of say di Chinese supermarket nor dey allow Nigerians enter to buy anything and dis na wetin oyibo dey call discrimination. Di closing of di Chinese supermarket happen after one of our active citizen com hala well well for him X handle. According to one of di video wey our active citizen share, im com tori how im bi…
Year: 2024
Edo State Health Emergency number na 112 or 739
If you dey Edo state, and you dey suffer from any health crisis or emergency, nor forget say help no far from you because emergency numbers dey to call. And di Edo state Emergency numbers to call na 112 or 739, and help go com meet you for where you dey. Make sure say you let people wey dey around you know say dis na d number to call incase anybody get emergency, even train your pikin wey dey as from 4 years old and e fit dey tok on…
Dem don declare govnor Aiyedatiwa of Ondo state di winner of APC primary election
Ahmed Ododo, wey bi di Chairman of di Ondo state govnorship primary election committee and also di govnor of Kogi State, don pronounce Mr. Lucky Aiyedatiwa as the winner of di primary election. Na early mor mor on monday nai Ahmed Ododo tori dis pronouncement say, Aiyedatiwa wey bi di current state govnor win di primary election with 48,569 votes, and im don becom di APC candidate for di govnorship election wey go happen for November 16th 2024.
Nigeria Army don dismiss two officers becos of thief thief mata for Dangote refinery
Nigerian Army don tori say dem don dismiss two soldiers wey bi Corporal Innocent Joseph and Lance Corporal Jacob Gani, sake of thief thief mata wey concern armoured cables for inside Dangote Refinery wey dey Lagos State. Na Major General Onyema Nwachukwu, wey bi di spokesman for army nai tori dis one on monday, im com say dis thief thief mata happen on April 14 2024, and dem wan com update di people on how far dem don go with di investigation. Major Onyema com tok say, after dem carry…
Conscience, Your own still dey work?
Dis conscience sef, na wetin e mean? conscience na dat feeling or dat voice wey dey inside you, and dey let you know say you don do bad tin or you don do good tin. Di good tin be say, everybody for dis world get dis conscience, so dat nobody go fit lie give theirself, except say dat person don just decide to kpai im conscience finish. Now, dis na wetin conscience dey do, if you bi bad person, conscience go let you know say bi bad person, if you…
Navy don arrest about 75 people wey be wan japa under bottom of cargo ship
Nigerian Navy don tori say dem don arrest about 75 people wey be wan japa comot from di kontri through di bottom of cargo ship, and dat na wetin oyibo dey call stoleaway. According to Commodore Adams Aliu, wey bi di Director of Naval information, dis attempt na criminal offence and e carry heavy consequences if dem catch you. Navy com warn say apart from say stoleaway na criminal offence and di heavy consequences wey e carry, stoleaway na very dangerous way to wan take japa, becos e fit lead…
Lagos State Police don apologize say na mix up for DJ Switch
Lagos state police don apologize over di mix up wey dem be tori earlier regarding di arrest of DJ switch. Dem com tori say na mix-up, say na DJ Commissioner Wysei nai dem arrest and nor be DJ Switch.
FCCPC don go lock 4U supermarket
Di Federal Competition and Consumer Protection Commission, FCCPC, don put selotape for di ogbonge 4 U supermarket wey dey Wuse 2 for Abuja, becos say dem dey sell bag of rice wey nor correct and dem com dey hide beta information. Dis kind practice according to di acting executive vice chairman of di commission, Adamu Abdullahi, dey unacceptable, dat is to say di commission nor go gree for dis kind wayo practice. Di commsiison according to tori, com make sure say, base on how people take dey complain say, dollar…
EFCC don declare Yahaya Bello wanted
Di Economic and Financial Crimes Commission, EFCC, on Thursday, April 18, 2024 com declare former govnor of Kogi State, Yahaya Adoza Bello wanted becos say im nor gree appear for court for im connection inside alleged money laundering wey reach N80.2 billion. Dis tori dey inside di EFCC website, and dem say anybody wey get information about di corner wey di former govnor dey, make di person contact di commission or di police station wey dey near dem.
Aisha Yesufu say if she bi presido, Kogi governor for nor try wetin im try yesterday for Abuja
Aisha Yesufu wey be human right activist, don tori for her X handle wey we first dey call twitter say, wetin happen yesterday between former governor of Kogi state Yahaya Bello and operatives from EFCC for nor happen imagine say she bi presido of Nigeria. Our current presido na Bola Ahmed Tinubu. Di human right activist com say, e bi like say she for nor gree for anybody, not even di current govnor of Kogi State, Usman Ododo wey tori carry say nai im com stop di arrest. EFCC be…