D Economic and financial crimes commission EFCC for Uyo Akwa Ibom state, don dey investigate 10 suspects wey dey deal on illegal petroleum product without d correct license. Na Mr. Dele Oyewale wey be d head of media and publicity for d commission, nai tok dis mata for one statement yesterday. According to Mr. Dele, na d Nigerian navy forward operating base nai catch dem with their ship and come handover dem give EFCC. D Navy handing over officer, Captain Uche Aneke, com tok say dem go continue to dey…
Year: 2024
Belief system
Wetin be your belief system? if you fit change your belief system, most of d tins wey you dey struggle with go change. So, as you dey start your day, ask yourself say wetin be dat tin about your belief system wey you need to change right now, and den you go come take beta concrete steps to see say e change, and then watch as tins go come start to improve. Have a blessed day.
Herbert Wigwe, wife and son don go home finally
Dem don finally bury Herbert Wigwe, e wife and e pikin for im hometown omueke, Isiokpo for Rivers state. Plenty people from all works of life follow attend d funeral church service wey happen for Redeemed Christian church of God parish for Isiokpo, before dem come go bury dem privately. We pray to God to grant dem eternal rest and make Him give d family d grace to bear dis loss wey we nor just understand.
Lion nor dey think like sheep
Lion nor dey think like sheep or care about elephant, im just know say na im be d king of both d jungle and d forest. As you dey start your day, make u make up your mind to think like d lion, so dat u go handle any mata wey go arise like d lion. Make yu enjoy your day.
Civil society council don beg presido to appointment new humanitarian minister
D national civil society council of Nigeria (NCSCN), don beg presido make e take am as quick mata to appoint new minister wey go dey in charge of activities for d humanitarian ministry. Remember say president Tinubu sack Beta Edu wey be d former minister for humanitarian affairs and poverty alleviation becus of d plenty wahala of mismanagement and money wey dem transfer to d wrong accounts, and since that time d ministry never get any minister. D civil society council com tok say d mata wey happen d last…
NIN matter,Nigerians for abroad don appeal to CBN to remember them
Nigerians for abroad don lament say CBN wey be central bank of Nigeria nor carry dem along on top d NIN linkage matter. Na Clement Osuya wey be d presido of d world united consumer organization nai tori dis mata for one interview, im talk say CBN nor even give any direction on d way forward for Nigerians wey dey d abroad on how dem go take waka for d linkage of d NIN wey CBN say d deadline nah March 1st 2024 wey don already pass. Osuya com beg…
FG don talk say health workers must resign their appointment before dem japa
D minister of state for health, Dr. Tunji Alausa, don tok on Saturday say federal government don give direction say any health worker wey dey plan to pack go d abroad wey we don know as japa dese days must resign deir appointments before dem japa. Dr Alausa com tori dis one when im visit d Neuro-Psychiatric hospital, Aro, for Abeokuta, Ogun State. D minister tori say no more leave of absence as dem dey do am before, and dis order dey among d executive order wey presido sign as…
Police don rescue 16 pregnant girls and eight babies inside one baby factory for Abia state
Abia state police command don catch baby factory for Aba, and dem don rescue 16 pregnant women plus eight pikins, wey be five boys and three girls, during d operation wey dem carry out on Thursday evening. One police officer from d rapid response squad wey dem for parade d women on Friday, com tok say dem rescue d women based on d information wey d people wey dey around give dem. D rapid response squad officer tok say, d building wey all dis for happen so, na for one…
Minister of interior don tell Nigerians for abroad say the sweet experience im promise don land
D minister of interior, Tunji Olubunmi-Ojo, don tori am for im X handle today to Nigerians wey dey d abroad say, d sweet experience wey im promise dem regarding d softness to get new or renew their international passport don com. Minister Ojo say Nigerians abroad go com fit dey apply for their passport from inside their house. And to do dis one, u go need to visit d website to apply as u dey see am for d picture. We just wan troway salute to d minster for bringing…
Tony Elemule don advised federal government to privatize transmission lines
D chairman of transnational corporation (Transcorp) and united bank of Africa (UBA) don advise government to change d power sector, and make dem also privatize transmission lines wey go help d economy grow, as e be say d economy just dey struggle. Na for d interview wey im sidon with Bloomberg na him for tok say d wahala wey dey d electricity market nor make any industry grow becus of poor production. Oga Tony com tori more say nor be good tin say Nigerians still dey depend on generator dis…