No more sharing money for stake wey get holders

Governor Alex Otti of Abia state com tori for one video wey omoelerinjare share for deir X handle say no more sharing money as dem dey do am before. D governor tok say some people wey say na dem be stakeholders of Abia, dey fight back becus say im administration nor gree share money. Governor Otti com tok say im nor go ever share money, so make those wey dem say dem be stakeholders find sometin else do, and im nor still worry since Abia people dey see wetin im…

Federal govt don tok say repayment of student loan na 2 years after youth service

Federal government don tok say people wey benefit from d Nigerian education loan, go get two years after dem serve youth service finish to pay back. Na d executive secretary of NELFund, Dr. Akintunde Sawyer, nai tori dis for d interview with News Agency of Nigeria for Abuja. E tory say d reason for d two year grace after youth service na to give all beneficiaries borku time to get work, and den repay d loan after dem stabilize. Him com further tori say dem nor go still put pressure…

Man don beat e wife die for Rivers state

Tori tok am say one man wey get three pikin wey dem dey call Michael Chiozie for Rivers state don beat e wife and kpai am on top house rent mata. . Dem say d suspect kpai e wife wey her name be Ufuoma Chidozie on Tuesday for Mile 4 area for Port Harcourt. D police public relations officer of d state command, Grace Iringe-Koko com tok yesterday say dem don arrest d suspect wey be Michael Chidozie and don hold am on top d mata say e beat e…

Government don open one new satellite pay Tv

Federal government on thursday for Abuja com launch one new satellite pay television wey dem tok say go give Nigerians better service for their money. Na George Akume wey be d secretary to d government of d federation wey e senior special assistant Prof. Babatunde Bernand represent, nai com open dis Nigerian satellite television wey happen for d shehu Yar’Adua center for Abuja. Congratulations Nigerians.

D future of our youth dey Nigeria

D president of Africa development bank (AFDB) Dr. Akinwunmi Adesina don tok say d future of our youth nor dey d land of any other country but instead na Nigeria here nai dat future dey. Dr. Akinwunmi tok dis one during d 2023 Awolowo leadership prize ceremony where dem for give im d award. Dr Akinwunmi com advised say instead of make d youth dey choose to japa, wey nor dey bring about better development, make we d youth take pride in wetin we get as per d youth power…

Money wey dem print from 2015-2023 nor match with productivity- Edun

D minister of finance and coordinating minister of economy Wale Edun don tori senate committee on finance on wednesday say na d N22.7tn wey central bank of Nigeria tru d ways and means overdraft for government under Buhari from 2015-2023 nai land Nigeria for d heavy inflation wey d country dey face now. Oga minister com tok say dem just print money anyhow and spend am anyhow, and dem nor com make any effort to put d reckless spending side by side with productivity. but d senate com tok say…

What is Herbert Wigwe’s Tribute Teaching All Of Us

It appears Herbert Wigwe may have impacted more lives even in death, may his gentle soul and that of his wife Chizoba and his son Chizzy rest in peace. I wish that everyone, including me will live each day as if there is no tomorrow, and that we will make each day purposely count, both on how we treat ourselves and how we treat others. I am emotionally drained watching the night of tribute and listening to how Herbert had touched so many lives even though I never knew him…

Court don talk say Abure remain Labour party’s chairman

D court of appeal for Abuja don tori say Julius Abure remain chairman of Labour party. Justice Harma Barka wey deliver dis judgement come tok say mata wey dem bring against d chairman and others wey dem accused, na mata wey don pass before d election wey we dey call pre election matas and na also internal affairs mata wey nor suppose to even come court of appeal. D court come also tok say d people nor fit prove d allegation wey dem accused dem for.

Federal government don talk say dem go collect discos license back

Federal government com tori on wednesday say dem go withdraw all d licence wey dem give discos since dem nor dey gree supply light wey dey cause black out round we country. Minister of power chief Adebayo Adelabu nai tori dis mata for im X handle say despite effort from FG, some of dis power distribution company dey purposely nor dey wan give people light. Oga minister com still tori say as from now on, im go hold all of dem wey no wan dey supply light responsible including to…

Edo state house of assembly don tok say dem go impeach deputy governor Philip Shaibu

Law makers for Edo state come tok on wednesday say dem go impeach deputy governor Philip Shaibu sake of say e be like say e come go tori some kind mata wey concern d government for outside. But some people like d conference of registered political parties for Edo state com tok say dem no support d impeachment wey be like say dem start on March 5th and 21 members of d house don already sign am. Nor forget say nah last week nai Philip go d national secretariat of…