Nigerian presido, Bola Tinubu, on Wednesday com sign three executive orders on top d oil and gas sector to bring fiscal incentives for related projects, reduce costs and time wey dem dey take do contract, and promote cost efficiency for local content requirements. One statement from d special adviser to d presido on top media and publicity, Ajuri Ngelale, come tok say d policy directive wey presido give na to improve d investment environment and make Nigeria be d preferred place for investors wey dey eye d oil and gas…
Year: 2024
People don dey para and protest for d poor state of Auchi Road
Protesters wey dey under Concerned Citizens of Edo State on Tuesday block Jattu axis for Benin-Auchi Highway sake of say d road dey very bad. D protesters wey come from different communities for Auchi com disturb business and movement of vehicles becus of d way d road take bad. One protester wey im name na John, tori give journalists say dem dey protest to show say dem no dey happy with how d federal roads for d state be, especially d Okene-Auchi-Ekpoma-Benin expressway. E tok say dem dey vex becus…
President say dem don attract $30bn direct investment
President Bola Tinubu talk say im administration wey never reach one year don attract $30 billion direct foreign investment commitments to help boost d Nigerian economy. Tinubu tori dis one for d 2023 Leadership annual conference and award for Abuja. D event, wey get d theme “An Economy in Distress: The Way Forward”, wey d Leadership Group of Leadership Newspapers organized. Tinubu, wey d minister of Information and national orientation, Alhaji Mohammed Idris represent for d event , tok say Nigerian economy no dey inside wahala, but e dey face…
PDP don talk say dem go dey wait for Philip Shuaibu wey be Edo state deputy governor for court
D Peoples Democratic Party (PDP) don tori say dem legal team dey wait for Deputy Governor of Edo State, Philip Shuaibu for court over d mata of d party primary election wey happun for d state. Na d deputy national publicity secretary of PDP, Ibrahim Abdullahi, nai tori dis one, and add say d party no dey shake for d deputy governor threat to carry d mata go court to declare am as d authentic PDP candidate ahead of d state governorship election wey dey come for September. Abdullahi tori…
EFCC don catch 21 trucks wey be wan thief our food go Cameroun and nearby countries
EFCC operatives for Maiduguri zonal command don catch 21 trucks wey full with food and other things. D anti-corruption agency tori say d trucks dey waka go N’djamena, Chad Republic, Central African Republic, and Cameroon. D agency tori say dem intercept d trucks for major road junctions for Kalabiri/Gamboru Ngala and Bama roads for Borno State. D agency tori say dem see food items wey dem hide inside d trucks, but dem catch am because their eye dey shine like eagle. Dem talk say dem check d papers wey cover…
Wike don set up FCT civil service commission
D minister for federal capital territory Nyesom Wike don announce on monday say im go set up civil service commission for capital territory. Na d meeting wey im hold with directors of FCTA and d Federal capital development authority FCDA nai im for tori dis one, im come still tori say d commission go appoint nine permanent secretaries to handle secretariats. Oga minster Wike come tori say d secretariats na transport and economic planning, agriculture and rural development, revenue generation and public private partnership, education, social development, legal services ,area…
Obi say e dey painful say na Ukraine come dey donate food give Nigeria.
D presidential candidate of Labour party for d 2023 general elections Peter Obi, don tori say, e dey very painful say na Ukraine wey dey fight war with Russia nai come dey donate food give Nigeria. Him tori say even though d food donations good, but e still go to show how d government of d day don fail to take care of e people. Peter Obi tori for am for im X handle say, d mata come dey be like national disgrace sake of say Nigeria wey God bless…
Marwa don advise parents to dey monitor their children very well
D chairman of Nation drug and law enforcement agency NDLEA rtd General Mohammed Marwa, don advise parents to dey shine their eye for their children body because of d so many drug abuse mata for d country. Him tori say make parents dey try to give better care to their children sake of say this fit help prevent d drug abuse wahala. D oga tori dis mata for d ramadan lecture wey d Alhaji Mohammed Lawal memorial jummat mosque, Asokoro, Abuja organize. E tori say d prevention efforts wey dem…
Buhari leave poor economy for Tinubu- Muftwang
D Governor of Plateau State, Caleb Mutfwang don tori say na Buhari administration nai cause d hardship wey Nigerians dey face right now. Him tori dis one on monday when im dey swear in 22 special advisers and heads of government agencies for government house Jos. D governor come talk say dem sell Nigeria future under d last administration wey dey under Buhari sotey dem print a whole 30 trillion naira and just share am. D governor come continue to tori say e owe d people d truth even though…
Idahosa say na him be authentic APC governorship candidate for Edo state
Dennis Idahosa of APC don write to d chairman of Independent national electoral commission INEC say make e no accept d name of any other candidate becus say na him win d governorship primary election wey dem hold on February 17th 2024. Nor forget say dem later declare d primary election inconclusive and come hold another supplementary election where d party for come declare Sen. Monday Okpebholo d winner of d APC primary election. Dennis tori for e letter say, na him win d February 17th 2024 primary election wey…