Youth Unemployment Benefits….

We D People, federal government don tori say e go stretch the catapult of social security payment to youth wey no get work for d country, nah after d execute meeting wey take place on monday nai d coordinating minister for we nation Wale Edun tori we d people, him come tori say dem go set up consumer credit scheme wey go help to cool down d wahala of d adjustment wey we d people dey face right now. Minister Wale Edun come still tori say when we d people…

Naira advocate

Our able senator, Senator Ned Nwoko wey dey represent we d people of Delta North don tori say make all the moni wey go dey exchange hands for the country be only naira and make dem ban am for dollars, say na becos of dollars nai make our ognonge beta naira come be like say e nor come get value. The husband of our beautiful nollywood actress wey be Regina Daniels tori this tori for the senate talk talk section, our senator tori say if dem fit ban dollar, naira…

Ballot Development

We say if ballot box and paper reach every community for we kontry, then ballot development supposed to also reach all we community. And this ballot development wey WE D PEOPLE dey ask for nor pass say make gorment give us enabling environment wey go make life beta for us, and that kind environment wey we dey ask na say give us constant electricity wey be light because na electric nai be city, give us good road and kontiniu to maintain the road for us, give us better building as…