Anytin you dey do, try to dey do am well

Di rison why you nid to do anytin wey you dey do well bi say, you nor go boda to luk luk back wen you dey waka, and dat nah beta peace of mind, and dat peace of mind na wetin any amount of money no go fit buy. So, as you dey start your today, remember your peace of mind wey no amount of money fit buy, and make sure say you dey do anytin wey you dey do well even if nobody dey look you, plus especially wen…

Nigeria don dey prosecution 2 chinco pipo and others for illegal mining

Nigeria gworment don charge seven suspects wey include two Chinese pipo go court becos of illegal mining activities for Kogi and Ondo state. Na di mining marshal wey bi di enforcement unit wey dey regulate and secure mining sector for Nigeria nai arrest all d suspects for one new operation wey dem carry out. According to di tori dem don charge all di suspects go court for Abuja.

Enugu gwornor don honor Mike Ejeagha di gwo gwo gwo ngwo master

Enugu state gworment don rename one Obinagu road wey bi popular well well to Mike Ejeagha road for Abakpa Nike for Enugu state. Remember say Gentleman Mike Ejeagha as dem dey call him nai bi di 93 years old wey sing gwo gwo gwo ngwor wey don go viral since after Brain Jotter wey bi content creator use am take do dance challenge. According to as di Enugu state gworment take tori am as him dey commission di road, him say apart from say dem name di road after di…

Dem don kpai senior special assistant for Edo

Tori dey report say some pipo wey bi suspected gunmen don kpai Mr. Samson Omoarebokhae, wey bi senior special assistant to di speaker of Edo State House of Assembly, Blessing Agbebaku.  According to di tori, dis mata happen for August 31, 2024, wen Samson Omoarebokhae dey return from Ozalla community to Uhumora community wey dey Owan West local gworment area for Edo state, nai dis suspected gunmen walay am come kpai am. Ivy Adodo-Ebojele wey bi di special assistant on media to di speaker tori dis mata for di condolence…

Dele Momodu don tori say him hope say Senator Adams Oshiomole go apology to Obaseki

Dele Momodu tori for e instagram page say him go hope say Adams Oshiomole go apologize to Obaseki and e wife over di comment wey him make during di weekend wey make social media bi wan catch fire. For di video wey everybodi dey provoke put, pipo hear wen Oshiomhole tok say Obaseki and e wife no get children, and upon say dem nor get children, dem nor fit adopt becos say e bi like say dem nor like children even though both Obaseki and Betsy e wife don dey…

Police for Toronto don arrest di 9ja woman wey say she go kpai Edo and Yoruba pipo for Canada

Toronto police don tori for dia website say dem wan let di general public know say dem don arrest Amaka Patience Sonnberger, wey make wan hate incited speech say she go start to kpai Edo and Yoruba pipo wey dey Canada by putting okpor for dia food for her place of work. Dem tori say na on Sunday wey bi September 01, 2024, nai dem arrest Amaka for Toronto and dem com charge am say she use threat against certain pipo, police say, Amaka go appear for Ontario court of…

One native doctor for Edo state don kpai e client wey bi com do bulletproof okpor

Police don arrest one 19years old Timothy Dauda for Edo state, sake of say him shoot e client, kpai am as him dey wan test di bulletproof charm wey him do for di client. According to di tori, dis mata so happen for Onumu community inside Aoko Edo local gworment area for Edo state. Police informate com tori say, di native doctor know how to prepare charm for pipo against gun and cutlass, nai make dis e client wey him kpai so wey dem dey call Alex Ezekiel bi go…