According to as FAAC take tori am, dem tori say regions for kontri reciv VAT sharing as dem still take contribute am for Q1 of year 2025.
FAAC tori say , Southeast Contribute N28.37bn and dem reciv N104.50bn, wey come make dem receive 368% of wetin dem contribute.
Dem say Northeast contribute N30.04bn and reciv N124.20bn dat is to say dem receive 345% of wetin dem contribute.
E come follow by Northwest wey contribute N68.05bn and reciv N176.74bn, which is to say dem reciv 260% of wetin dem contribute.
Na dere nai North central for contribute N52.70bn and reciv N126.16bn wey come make am be say dem reciv 239% of wetin dem contribute.
As e reach South south turn, dem say di region contribute N364.99bn and reciv n171.19bn wey come turn am to say dem reciv 47% of wetin dem contribute.
Dem tori us las las say di Southwest region com contribute N929.87bn and receive N258.19bn wey come be 28% of wetin dem contribute.
No forget to kontiniu to folo us for more ogbonge tori as dem dey hala ram.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.