Our pipo for Benue IDP camp dey ask say wey di food wey di aid wey di relief materials?

Our brothers and sister, mama papa and pikin dem wey dey one IDP camp for Benue state especially becos of di recent kpai kpai wey just happen few days ago for Yelwata don come out come protest heavily for Makurdi say dem wan use hungry take kpai dem finish o. Dis our pipo wey need help like yesterday don cry com out dey accuse di state gworment and officials for di camp say dem dey hide and divert di relief materials wey pipo wey get beta mind don donate for…

63 billion naira to renovate gworment house for Oyo state

Dem say di Oyo state executive council don approve di sum of N63,479,858.000 make dem take renovation di gworment house. Na on Wednesday wey just pass so nai dem tori say dis governing council com approve dis amount wey brekete borku for everywhere so. Dotun Oyelade wey bi di commissioner for information and orientation for di state com tori say di rixon wey make di executive council dem approve dis amount for di renovation bi say di current gworment house bi like embarrassment, and on top of dat both di…

See as Pastor Enenche take advise say make dem go give di 30 milla to orphanage

According to the tori wey una dey see for dis church gist video, Pastor Paul Enenche wey bi di pastor of Dunamis International Gospel Centre come go hold crusade for Kebbi state, na dere we di pipo for see say some men come mount di podium say di gwornor of di state say make dem come giv di Pastor 30 million naira, that is to say Kebbi pipo money, like tax payer money. But as di men wey we dey look ayanyan so dey announce di amount wey dem say…

Ugandan young people make una gather here

We say make di young pipo of that our sister kontry wey we dey call Ugandan gather here, make we ask them small question regarding dis video wey dey fly upandan for social media. Pipo dey ask say weder dem use wrapper cover di face of di young men and women wey dey Ugandan? As e come be nah, na only di young pipo of Ugandan nai go fit answer weder dem use wrapper cover dia face for inside dia kontry, but in d mintime na di videos wey dey…