According to the tori wey una dey see for dis church gist video, Pastor Paul Enenche wey bi di pastor of Dunamis International Gospel Centre come go hold crusade for Kebbi state, na dere we di pipo for see say some men come mount di podium say di gwornor of di state say make dem come giv di Pastor 30 million naira, that is to say Kebbi pipo money, like tax payer money.
But as di men wey we dey look ayanyan so dey announce di amount wey dem say na gwornor nai bring am sake of say e see say di pastor dey do beta thing with di crusade, na so di pastor and e wife Pastor Mrs. Enenche dey reject di 30 million sharp sharp.
Di pastor come advise di men say make dem kuku carry di money go use do sara for any orphanage home’s, sake of say gworment money na for di state pipo and nor bi for church.
You know say dat man wey dem call Myles Munroe tori am for one of e message dat year say, if you nor know di purpose of a thing na so u go abuse am.
Shey dem be wan go give 30 million naira of Kebbi pipo money since nobodi go ask questions, no checks no balance. Meanwhile d money wey dem dey blow upandan na Kebbi pipo money o, nai bi wetin dis pipo nor understand say, dem elect dem to serve nor bi to dey spend state purse as dem want am.
Discover more from WE DI PEOPLE
Subscribe to get the latest posts sent to your email.