NAFDAC don close one kurukere alcohol factory wey dey operate for Lagos Island yonda

Di National Agency for Food and Drug Administration Control wey be NAFDAC, don tori say dem don catch some people wey dem believe say dem dey produce alcohol illegally for rooms wey dem turn to factory inside area for Oke-Arin market.

Dem tori further say after di catching wey dem catch catch dem, NAFDAC come seize goods wey reach almost N200 million, na for dere dem come beg everybody to shine dia eyes well well especially wen dem dey want buy anything alcohol or beverages.

Na three suspects dem arrest during dis catch catch and dem say once dem conclude investigation dem go start to prosecution the suspect them.

Please share

Discover more from WE DI PEOPLE

Subscribe to get the latest posts sent to your email.

Related posts

Leave a Comment